Sunday, 6 September 2015

Innjoo To Knack Two Giant Affordable Device Soon!!!


Innjoo no gree again o as them yarn say them wan take over the mobile industry in Africa from dem Tecno and Infinix wey dey follow them tranga for the matter. Innjoo recently announce say them go release two affordable Android Device wey go fit stand gidigba for the Naija market. The phone as them talk am get many tanda property wey go make am take over the market in a micro tin tin time. Hey!!! Hey!!! Hey!!!

The first of the kind na the Innjoo Halo, wey go follow come with 3200mah battery wey fit serve better pass most phone for the price if #13,999. Cheap kwa!!!. With a display of 5"inches and hd quality of 5mp back camera and 2mp front camera. The phone too make sense.  Make una dey save up ooo, time don assist reach to buy better
The matter no end for there, as I talk am, na two gidigba phone Innjoo plan launch so, and the second phone na Innjoo fire plus. This one tanda wella pass the first Ofe o. With 13mp back camera and 5mp front camera, ewo you go fit capture angel Gabriel with am live and direct. Wetin con sweet pass for the phone be say, e get 3600mah battery wey fit last pass two days if person gree use am wella. The price for this one con high small sa, #28,000.00 but person wey go chop better soup, go put better money for table. No be so??

Unto say the phone dem get better property o, the software wey them yarn say dem build inside na baba as e dey quick charge and dem get 1gig and 2gig ROM respectively. So my brother and sister, if una like and sabi to pay game join am with drain battery, e be say, you don get the right phone for your mind now. Make una wait patently like saybaba...you go soon dey reap the fruit of una saving. 

No comments:

Post a Comment

Contact Us
Email: publisher@absolutehearts.com
Phone/whatsapp: +2348027922363