Saturday 28 July 2012

Funny: How to "mess" in the public without gettin caught.

* AdvIcE No Be CursE! ;DTutorial: HOW TO MESS IN PUBLIC & RETAIN UR IMAGE.
To mess for public dey sweet but if dem catch u, no be small embarasment o!
Just folow dis guidelines & u are on ur way to being a star
in dis profession.
1. Wen u enter a hall, check d wind direction, if na closed hall wit AC, better. Maximum impact.
2. Make sure say u sidon face d wind direction.
3. Make sure say u get enof leg space. U go soon knw why.
 4. Form ajebo by crossin ur legs every now & then.
 5. U don ready 2 execute, try hold am until time wey d hall
dey noisy incase ur mess na d type wey dey sound like AK47.
 6. Now carefuly cross ur leg, right over left.
 7. Elevate d right yansh.
 8. Release small (sound
check)
 9. If no sound, allow make d mess flow steady.
 10. Allow time 4 proper
circulation.

NOTE:
 1. Make sure say no be u be d first person 2 complain.
 2. Wen pple begin dey shout "chineke! E no go better for d person wey do dis kind thin,"
simply ask "why person no fit respect d presence of odas
na?"
 3. No hala pass odas if not u go become suspect.
 4. Take style disengage from d area, relocate to another zone and repeat d exercise.


Comment and post your crazy joke

No comments:

Post a Comment

Contact Us
Email: publisher@absolutehearts.com
Phone/whatsapp: +2348027922363